
Nigerian President, Goodluck Jonathan, don arrange one Presidential
intervention scheme, to take help improve the level wey Nigeria Movie Industry
take be now.
The Project wey dem tag as “Project ACT Nollywood” wey just be like dat
N3 Billion wey president Jonathan give Nollywood 4 years ago to help dem
improve film Production.
Una go remember say, President Jonathan, bin do Private meeting with
some important pipo for the entertainment Industry, for Lagos, for January 24th
2015.
We no quick know wetin dem tok for the meeting, but last week naim the
Federal Government, launch the N2 Billion Innovation Distribution Fund (IDF),
wey go dey to improve how dem take dey distribute Audio-Visual content, and
stop Piracy for our Country-Nigeria.
No comments:
Post a Comment