Federai Government don comot con tok yesterday say, nothing like Bird Flu dey for Obasanjo Farm wey dey for Otta, Ogun State.
Na for the Press Statement wey the Federal Ministry ontop Agriculture carry comot dey tok say, wetin National Daily bin carry say, Bird Flu don dey for Obasanjo farm, na big lie, as dem sef don check and see say nothing like dat dey for our country, wey don already dey make Naija pipo dey fear now.
The Statement wey na Minister of Agriculture, Dr Akinwunmi Adesina, naim sign-am tok say, after ein read for paper say, something like bird flu dey for the farm, naim ein sef con send pipo go the farm to go check the place well-well, weda na truth say something like dat don showface.
Dr Akinwunmi wey con still send message go give the commissioner of Agriculture for Ogun State, Ronke Sokefun, to send pipo go dia sef to see wetin really dey happen, and after dem do plenty investigation, dem see say, nothing like dat dey for the farm.
Ein tok say, even though say, Ogun state na one of the state wey dem bin don report say the bird flu dey showface, but for now nothing like dat for Obasanjo farm , but for the place wey dem for don see am, dem don quarantine the place from public pipo.
No comments:
Post a Comment