Friday, 20 February 2015

Mali don sign Peace Deal with 6 Militant Groups

Image result for mali peacekeeping 


The Government of Mali, don agree on thursday to enter beta ceasefire deal with 6 different militant group for the country, as United Nations dey sponsor to stop the gbege wey dey for the country for some time now.
Na the Foreign Minister for the country, Ramtane Lamamra, tok say, deal wey dem enter so, no include dose group wey dey linked with Al-Qaeda militant group, as the plan na to create beta peace for dem.
The deal wey dem sign soo, na for the front of Lamamra and Mongi Hamdi wey be the Head of 9,300 strong UN peace mission for Mali (MINUSMA).
the peace deal come after the 5th sidon tok wey dem do for Algier wey start for Monday dis week.
From the Document wey PidginDigest see, dem agree to cease fire fromn every violence for the country, and to stop use mouth curse or insult dem self.

No comments:

Post a Comment