Boko Haram Jaguda Group don threaten Niger and Chad, wey
be neighbouring countries to Nigeria say, since dem wan dey send soja to fight
dem, dem sef ready to send suicise bombers to go blow the two country.
Boko Haram fire dis warning as leaders from Niger, Chad
and oda west African Countries dey gather for Cameroon, to plan how dem go take
do joint operation to fight the Jaguda group.
For the translation wey intelligence pipo get from SITE
intelligence group, Boko Haram con dey squeeze face give Niger wey go join
wetin pass dia power, as na serious darkness the country wan enter soo, as
milliants don bomb the town of Diffa for the last 10 days.
According to wetin PidginDigest hear say, dem go launch
the multinational force next week, to take fight Boko Haram Jaguda pipo. The
countries wey promise to help Nigeria na, Cameroon, Chad, Niger and Benin last
week, but Burundi and Central African Republic don agree to join for the fight
against Boko Haram.
No comments:
Post a Comment