
One Suicide bomb attack don kill more dan 13 people for Potiskum, the north-east area of Nigeria today.
One person wey dey work for the Dan-Borno bus state station con dey tell news pipo say, the suicide bomber, bin wait make the 18 seater Bus full finish before ein con enter to blow the bomb.
As dis tori dey reach una now, na 13 deadbody we don fit count for dat place, and the bus wey blow soo, destroy reach ground.
Naija still dey face the hand of Boko Haram, wey don claim the life of Thousands of Pipo almost every day.
Eye witness tok say, the suicide bomber na woman e be, and una go remember say, on Sunday one small girl sef blow her sef and kill 5 pipo for one market for dat town too.
No comments:
Post a Comment