President Goodluck Jonatha, don beg dose member of PDP for House of Representative, wey dey vex right now say, abeg make dem forget any quarrel wey dem get, but try work with-am to win the March 28th Presidential Election.
PidginDigest gather say, President Jonathan dey beg dem, as ein meet with dem for Aso Rock, Abuja on Sunday night.
The Law Makers wey tok dia mind give President Jonathan on Sunday for ein Villa say, dem no happy with the way wey the PDP Leaders and dia secretariat just forget oda pipo wey wan still follow drag dat position, but dem con sell am give the person wey get money pass, wey no make sense at-all.
One of the Lawmaker from south south, wey bin wan be Governor for ein state, wey some pipo for the PDP secretariat bin dupe-am N1 Billion to take get-am chance to get the ticket to contest, but ein con dey thank EFCC wey Finally catch the pipo wey dupe-am, and dem don fit collect N500 Million of the money from dem.
Oda pipo con dey tok say, dem no happy as the leader for the party, no give equall chance to party members to fit join contest any position wey dem want.
No comments:
Post a Comment