Sunday, 22 February 2015

NFF Don yarn why dem invite Alex Iwobi

Image result for Nigeria Football FederationImage result for alex iwobi nigeria


The Nigeria Football Federation don finally comot come tok wetin really make dem carry Arsenal Player, Alex Iwobi, go Gabon for the 11th All-African Games Qualifying Match dis Saturday.
According to wetin we hear from Direcvtor of Technical for NFF, Dr Emmanuel Ikpeme, ein tok say, NFF make up dia mind to add the player join the squad, to take give chance to Naija players wey dey for other countries for the world to come join Nigerian National teams.

Ein tok say, the U-23 team na place to give players chance to fit move to go dey play with our Super Eagles, as na wetin NFF dey try build now be dat.

NFF tok say, wetin make dem invite-am come be say, ein go fit join oda players for here and dem go fit know dia sef, and dem go come write go give FIFA to fit finalise ein paper, to fit come anytime come play for super eagles anytime wey dem get International Friendly.

Oga Ikpeme con still tok say, dem go continue to dey invite dia kind player to come dey join any of our National team.

No comments:

Post a Comment