Thursday, 19 February 2015

Woman Naked Deadbody show face for Public




No be small Confusion, as the people of Umunneato autonomous community wey dey for Aboh Mbaise Local Government Area of Imo State, just dey scatter everywhere, as dem see naked deadbody of one woman from the community.

PidginDigest gather say, Dem see the deadbody, day after everybody for the World celebrate Valentine day finish, even for Okwu Village.

According to person wey see the deadbody wey no greet ok ein name, ein tok say from wetin dem see for the body, some kind mark dey the breast area and even the private parts, and dem no comot mind from say, na gang-rape e go be wey happen to the woman, as dem no even fit know the age or name of the woman soo.

The person tok say, dem no know how the deadbody take reach where dem for see-am soo along the road for Okwu or who even do-am.
The traditional ruler for the village, Eze Leo Nwokocha, say, dem still dey try findout who the woman bi.

No comments:

Post a Comment