Tuesday, 24 February 2015

IS Militant don Kidnap More dan 90 Christians for Syria

Image result for IS fighters



Dat Islamic State (I.S), don kidnap plenty Assyrian Christians from different villages wey dey the north-east side of Syria.

The Human Rights Observer for Syria naim dey tok say, na more dan 90 men, women and Children naim the terrorist group kidnap as dem go raid the town of Tal Tamr.

Tori tok say, some Assyrians manage escape go the east side of the country wey na where Kurdish pipo for get control pass.

Dis one wey happen soo, dey come as Kurdish fighters wey America dey support don dey get upper hand for the fight to stop terrorist work wey IS dey do for the country.

Even for Iraq, Kurdish Peshmerga fighters sef dey fight dem well-well comot from the areas wey dem dey control before now.

No comments:

Post a Comment