Monday, 23 February 2015

More 48 Pipo die for Ferry wey Capsized

Image result for ferry capsized 


According to tori, na more dan 48 pipo plus women and children naim dem don confam say die, after one ferry boat get accident with anoda cargo ship for Bangladesh river on Sunday.
Na the worst boat accident wey don shele for dat area for this period for the country, wey dem get plenty history of boat accident.

Dose wey dey rescue, don see 48 deadbody wey small pikin and 2 women dey inside, and one local officer, Rashida Ferdous con dey tell news pipo say, dem no even knbow the number of pipo wey dey miss now.

She say, one big boat don dey road to come drag the ferry boat wey sink inside water comot, and dem do arrest the captain and 2 crew members of the cargo ship wey jam the ferry boat.

From wetin we hear, the ferry boat wey be MV Mostofa with 2 deck, bin dey carry 140 passengers inside before the boat capsize inside the padma river.

No comments:

Post a Comment