Monday, 23 February 2015

Jonathan no gree sign paper with Yoruba Leaders

Image result for goodluck jonathanImage result for muhammadu buhari


PidginDigest don dey hear now say, President Goodluck Jonathan, no go gree sign any agreement with Yoruba Leaders ontop the General Election wey dey come for March next year.
From wetin we hear from reliable person for Abuja, as President Jonathan, dey tok which kind position ein go give South-West pipo if ein win the March 28th Presidential Election, but ein no gree sign any agreement with dem.

The Yoruba Leaders bin dey tell President Jonathan say, make ein sign put for paper, to show say, ein go keep ein promise to pipo of Yoruba Land if ein win the Election.

Oga Jonathan bin don ask the pipo of dat region make dem support-am, after ein do meeting with leaders for Ogun and Oyo state.

No comments:

Post a Comment