The Government of Borno State, don declare Monday as public Holiday, to take welcome the Presidential Candidate of the All Progressive Congress (APC), Gen. Muhammadu Buhari, wey wan visit the State.
Na the Sece to the State Government, Baba Ahmed Jidda, naim give the statement to news pipo say, na way wey dem want make the pipo for the State, make dem welcome Gen. Buhari, as ein wan come do ein Presidential rally.
Oga Jidda con dey advice the supporters of Apc for the state say, make all of dem comeout plenty to come show dia support to dia visitor wey dey come.
No comments:
Post a Comment