One group wey dey support President Jonathan, Jonathan and Gboyega Youth Movement, wey dey for Ogun state, don tok say, the presido candidate of All Progressive Congress, Gen Muhammadu buhari, no be person wey Naija pipo go fit trust to fight corruption for inside Nigeria if ein win the Election.
The group wey dey promote the work to re-elect Presido Jonathan and also the PDP Candidate for Ogun State, Prince Gboyega Isiaka, tok say, Buhari too dey weak to fight Corruption inside Naija.
The Coordinator for the group for the state, Fatai Adesegun, con dey accuse APC for one statement say, the party promote Government wey go make youth dey dependent ontop Government, and dem no go get mind of dia own again.
Ein tok say, for 39 years Old, Buhari rule Naija as Head of State, and after 39 years after, ein still wan come to come rule again for Democracy, wey mean say, no young person go fit lead naija pipo again? Abi na backward our country wan dey go?
<script type="text/javascript" src="http://s7.addthis.com/js/250/addthis_widget.js"></script>
No comments:
Post a Comment