Thursday, 19 February 2015

Police say no bail for any Jaguda wey dem catch with weapon

http://www.vanguardngr.com/wp-content/uploads/2013/12/police.jpg 


The Zone 10 Police Command wey dey for Sokoto State, don announce comot say, dem no go give bail to any Agbero abi Jaguda wey dem catch with weapon during any Political rally for that area.
Na the AIG for that Zone, Mr Bala Hassan, naim dey tok dis one for Sokoto today thursday say, as from now, dem no go gree give any jaguda wey dem catch with any weapon like knife, cutlass or wetin pass dos two, bail again, as na to charge dem go court alone.
Oga Hassan con dey tok say, dem go make sure say, any person dem catch must go court and face the law well-well, as na to protect the life and property of Nigerians naim be dia work.
Ein say, dem no go just fold dia hand dey look as some jaguda go just dey cause serious kata-kata, when be say na peace wey dey look for.
The Police Commissioner for the State, Mr Salisu Fagge, con dey promise say, dem go do every-every to make sure say, Election for dat area no get any problem.

No comments:

Post a Comment