
The Chairmo of INEC, Prof. Attahiru Jega, don tok say, dat card reader wey dem import enter our country, naim be the only thing wey dem go use to take do accreditation of voters for the general elections.
Prof. Jega tok dis one Yesterday as ein dey tok to Senate pipo for Abuja, ontop how INEC don take ready to do the General Election for Nigeria next month of March.
Ein tok say, na part of our constitution for dem to use the card reader to take acrredit voters, as dem no fit go back to the former way wey dem take dey do manual work.
Jega say, Inec no go allow make any person use Temporary viters card to take vote during the election, as some pipo don dey cry say, na wetin make dem use be dat.
ein promise say, id=f any of the card reader get fault, dem get anuff for hand to take replace am.
No comments:
Post a Comment