
According to tori, Boko Haram Jaguda pipo go attack one Gaya Village wey dey for Hong Local Government Area of Adamawa State, early mo-mo on Thursday.
From wetin PidginDigest gather be say, dem kill more dan 30 indeigenes for the community, wey near Sambisa Forest.
The members of Boko Haram con still use fire burn some building for the community reach ground before dem con run comot.
This attack soo, come after army free more dan 11 community wey the jaguda pipo bin don collect. Army bin kill more dan 300 members of the jaguda group, and dem con seizee plenty armunition from dem on tuesday.
No comments:
Post a Comment