The Governor of Ekiti State, Ayodele Fayose, don tell the Presidential Candidate of the All Progressive Congress (APC), Gen Muhammadu Buhari, say, make ein use the Holy Quran take swear say, ein no visit any Hospital for Medical check-up as ein travel go United Kingdom Last Weeks.
Fayose dey tell the Leaders for APC say, dem no try at-all, as dem no tell all Naija pipo the truth wey concern the Health-mata of dia candidate.
for the Statement wey Oga Fayose carry comot through ein Special Assistant ontop Communication-mata, Lere Olayinka, tok say, Buhari no fit be Naija Presido, as ein go fall the hand of naija pipo, and sey ein fit no last for Government.
No comments:
Post a Comment