Sunday, 15 February 2015

Niger Government don Arrest Plenty Boko Haram Supporters

Image result for female suicide bomber in nigeria



Tori from Local Governor for Niger Republic don announce say, the police for dia Country, don arrest plenty pipo wey dem suspect say, dem bin Supporters of Dat Nigerian Boko Haram Group, wey don dey cause serious attack for the country for some time now.

Kalla Moutari bin tell AFP yesterday evening say, Dem don arrest some pipo for Zinder region of the country, as ein tok say, dis pipo soon a citizen of Niger dem bi, and dem suspect dem as supporters of Boko Haram.
Ein con tok say, dem don send the suspect-dem go the Anti-terrorist Unit wey dey for the country capital city, Niamey.
Boko Haram members bin start to dey attack for the cross-border area of Diffa since February 6th 2015, inside Niger Republic, wey bin just Northeast area of Nigeria, wey bi the strong part wey Boko Haram for get power pass.
According to Government, Na the Access road wey lead to Zinder, for one check point naim dem for arrest the suspect-dem, wey bi the second largest city for the west of Diffa.

No comments:

Post a Comment