Sunday, 22 February 2015

Amunike say Golden Eaglet work hard to Reach where Dem dey now

Image result for Amunike


As the Golden Eaglets of Nigeria don qualify for the U-17 World Cup for Chile, The coach, Emmanuel Amunike, don tok say, na because the team dey very serious with training and dem dey determine, naim make dem fit reach where dem dey.
Amunike Team wey win 3-1 against Zambia on Saturday for Stade Municipal, to Qualify go the Semi-Final of the tornament for Niger and to come still Qualify for the World Cup, do serious work to fit reach where dem dey now.

Amunike tok say, ein team still dey improve for the game, but dem go continue to do more work and training to fit dey beta, before dem enter the knockout stage for the competition.

Nigeria wey lead for Group A for the 11th CAF Africa Junior Championship with 7 points form the 3 games wey dem play, go play South Africa, Mali or Ivory Coast from Group B for the semi-final.

The Former FC Bercelona Player, Amunike, tok say, ein team no get any team wey dem go prefare to playe for the semi-final, but na to concentrate on ein team to fit win every oda match wey dem get till final.

No comments:

Post a Comment