Sunday, 15 February 2015

Woman Suicide Bomber don Kill 7 Pipo for Damaturu

Image result for female suicide bomber in nigeria



According to Tori from our Nigeria Police, One female Suicide Bomber don kill more dan 7 pipo today Sunday for one Bus Station wey dey for the North East city of Damaturu, wey don make-am one of the Boko Haram Attack.

Na the Commissioner of Police for Yobe State, Marcos Danladi, Naim tok say, na the Central Motor Park wey dey for Damaturu naim di female Bomber for blow the bomb, and na only 7 dead body dem don see for the attack.
According to AFP, na 7 pipo dem confam say die and 32 pipo con Wounjure for the attack.
Dos wey see wetin happen tok say, the person bin enter the Motor Park inside one car, naim she come down con waka go one small stre wey dem for dey sell Food stuff, for the end of the park, wey she for con stand for where crowd dey wey she for con blow the Bomb.

No comments:

Post a Comment