The Presidential Candidate of APC, Gen. Muhammadu Buhari (Rtd), don
threaten say, ein go drag NTA and AIT go court, as dem dey show video wey tok
bad about am.
Dis one comot, just as the Nigeria Broadcasting Commission (NBC), don
warn all media house for the country say, make dem stop toi dey show wetin no
dey for the Broadcast law for our Country, wey fit make NBC sanction any of
dem.
For the protest letter wey the Legal Director of APC Presidential
Campaign Council, Mr. Chukwuma-Machukwu Ume (SAN), carry comot wey Buhari for
dey tok say, Make the 2 Television station stop to dey show the Video, and make
dem comot come Apologize for Public.
Oga Buhari say, ein go take the mata go court, if the 2 Television
station no gree come Apologize give-am.
No comments:
Post a Comment